Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Kolossians 4:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Like dis too, make una dey pray for us, so dat God go give us betta shance to tok about Christ sekret, wey make mi dey prison.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Kolossians 4:3
27 Iomraidhean Croise  

Jesus ansa dem, “God don make una know all di sekret tins about en kingdom, but dis pipol nor know.


Wen dem rish Antiok, dem gada di pipol kon tell dem all di tins wey God use dem do and how E open road for Gentile pipol to bilive.


Make wi praiz God, bikos e don make una strong thru dis Good News wey I dey prish about en pikin, Jesus Christ. For many years naw, dem keep dis message for sekret,


bikos plenty work dey wait for mi for der, even doh di shalenge strong well-well.


Make una dey tink about us as Christ savant wey God don show en sekret.


Wen I go prish di Good News for Troas, even doh Christ open door for mi,


Bikos of dis, mi Paul wey bi prisona for Christ, bikos of una wey bi Gentile pipol, dey pray give God.


God open my eye to undastand en sekret, as I rite to una before,


so dat wen una read am, una go fit undastand di sekret wey God show mi.


Di grace na to make evribody undastand God sekret plan. Na God kreate evritin and E hide di plan since e kreate di world.


Mi wey bi prisona, bikos I dey serve di Oga God; I dey beg una make una dey live una life as God wont.


bikos I know sey na una prayer and di help wey Christ Spirit dey give, dey save mi.


So e dey good for mi to dey tink about una like dis, bikos una dey my heart. Una don follow mi share from God favor, even wen I dey prison and wen I dey prish di trut about di gospel.


So di sekret wey E hide from awa grand-grand papa dem and evribody wey dey di world before, E don open am make en pipol si.


Mi Paul, dey rite dis greetin with my own hand. Make una remember di shains wey dem take tie mi and make God grace dey with una.


My brodas and sistas, make una pray for us.


Make God show en mesi to Onesiforus family, bikos e dey always make mi happy and e nor dey shame sey I dey prison.


and na dis Good News make mi dey sofa, sotey dem kon put mi for prison like tif; but dem nor fit put God word for prison!


Make yu dey prish God word and dey ready, weda di time dey okay or not. Make yu use patient take korrect and enkourage yor pipol with betta tishing.


So, make yu prepare where I go stay, bikos I know sey yor prayers go make dem free mi kom meet yu soon.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan