Jerusalem pipol, make una dey great and strong again! God holy town, make una wear pride like klot! Pipol wey nor know God nor go enter una gate again.
E go wear good judgement for body like war koat kon wear viktory like priest kap for en head. E go wear klot wey go make am do good tins kon ponish doz wey dey sofa pipol.
Make una nor bi like pipol for di world, but make una allow God shange una mind, den una go know how to serve God and do tins wey dey make belle sweet am.
Bikos God wey sey, “Make lite shine from darkness,” Na-im dey shine inside awa heart, so dat E go give us di lite wey show us en glory wey dey Christ face.
E don kansol Jew pipol law with all en kommand and rules, so dat e go fit make Jew and Gentile pipol to bi one with am and like dis, peace go dey among dem.
So, as pipol wey God don choose, wey holy and wey E love well-well, make una kwik dey sorry for pipol; dey gentol; nor dey karry body up and wear patient like klot for body.
And di Pesin wey sidan for di throne kon sey: “Make yu look! I dey make evritin new!” Den E kon tell mi, “Make yu rite all dis tins, bikos dis word na word wey pipol fit trust and na true.”