Afta una don do like dat, den God go sey, “Make una kom make wi setol di matter naw. Even doh una don stain unasef with blood bikos of una sin, I go wosh una white like snow. Even doh una stain red well-well, una go kon dey white like wool.
Make wiked pipol turn from dia wiked life kon shange di way dem dey tink. Make dem turn go meet di Oga wey bi awa God, bikos E dey sorry for pesin and dey kwik forgive pipol.
“Pipol nor go nid to tish each oda about how to know God, bikos evribody go know mi; both doz wey poor and doz wey get money. I go forgive dia sins and I nor go remember di bad tins wey dem do before. Mi, wey bi God, don tok.”
God word sey, “I don make yu papa for many nashons.” So for God eye, Abraham na awa papa, bikos e get faith for God wey get pawa to raiz pipol wey don die and to kommand tins wey nor dey before, like sey dem dey.
Make una nor let Satan use una body take do bad tins, but make una karry unasef give God as pipol wey don wake-up from deat, so dat una go dey do good tins.
If God Spirit wey raiz Jesus Christ from deat dey inside una, den en wey raiz Christ from deat, go give una body life, bikos of en Spirit wey dey inside una.
Di first man na Adam and God word sey, “Dis Adam na pesin wey God kreate like us. But Jesus, wey bi di last Adam, na pesin wey dey give life to pipol.”
Na God make us fit do dem, so dat wi go serve di new kovenant; dis nor bi di law wey dem rite, but na di one wey koncern God Spirit, bikos di law wey dem rite dey bring deat, but di Spirit dey give life.
So, bikos of Christ, God dey turn di world from en enemy, to en friend. E nor dey kount pipol sins against dem and E don give us di message wey go make pipol bi en friend.
Make una remember sey before-before una bi Gentile pipol wey dey do wetin di flesh wont and Jew pipol dey koll una, “pipol wey dem neva sekonsaiz” like di way dem dey sekonsaiz human being.
Bikos na lite dey make evritin shine kom out and na dis make dem rite sey: “Wake-up; yu wey dey sleep! Make yu raiz from grave and Christ go shine for yor life!”
E don rish wen wi go stop to learn only di first tins wey Christ tell us, so make wi dey grow kon know Christ more-more. Wi nor nid to still dey tish una about tins wey dey kause deat; why wi must bilive God;
wot of Christ blood wey klean us from deat, so dat wi go fit woship God? Dis na di Christ wey offa ensef to God as di rite sakrifice for awa sins and e do am with di Holy Spirit pawa.