Wi kon dey happy, nor bi only sey Titus kom, but bikos of di advise wey una gi-am, bikos e tell us how una won si mi; how una dey vex and worry for mi and my happiness kon pass as e bi before.
With difren prayers, make una dey ask God to help una. Make una always dey pray with di Spirit and dey shine una eyes well-well. Make una nor give up, but make una kontinue to pray for all God pipol.
Bikos of dis, wi too, since wi hear about una, wi neva stop to dey pray for una. Wi dey tell God make E show una wetin E wont, so dat una go dey wise and undastand God Spirit,
But naw, Timoti don kom meet us afta e si una and e tell us di Good News about di faith and love wey una get. E still tell us sey, una dey always remember and dey hongry to si us, just as wi dey hongry to si una.
God nor dey support pipol anyhow. E go remember how una help en pipol before-before and how una still dey help dem naw. Una bi God pipol and E nor go forget di love wey una show en shidren.