Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Kolossians 1:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 Bikos God kreate evritin for heaven and eart thru en pikin; both Fisical and spiritual tins; weda dem get pawa or dey rule for difren-difren place; God kreate dem thru am and E kreate dem for am.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Kolossians 1:16
29 Iomraidhean Croise  

Yu dey great and get pawa; Yu get glory, honor and respet. Evritin for heaven and eart, na yor own and dis na yor kingdom. Wi dey praiz Yu pass evritin for dis world.


Na only Yu bi God. Na Yu kreate di heaven and di stars for sky. Yu kreate land, sea and evritin wey dey inside, den kon give dem life. All di pawa for heaven, dey bow woship Yu.


Evritin wey God kreate get en purpose; but na wahala, wiked pipol go get.


Na mi form dis pipol for mysef and dem go sing praiz mi!”


Dis na wetin God wey save una, di Pesin wey form una for una mama belle dey tok: “Na mi bi God wey kreate evritin. Na only mi stresh di heavens kom out kon design di eart as I wont.


E kom inside di world wey e make my ensef, but di pipol nor know am.


Na God make evritin and if to sey E nor make dem, dem nor for dey dis world at-all.


Bikos na God kreate evritin and na thru am evritin dey. Make praiz bi en own forever and ever! Amen.


But I dey sure sey, weda na deat or life; angels or wiked pawas; tins wey dey naw or di ones wey dey kom;


Awa grand-grand papa dem wey follow God waka before, na from dem dis pipol from kom. So I dey pray make dem praiz God wey dey rule evritin forever and ever! Amen.


But wi (wey bi Christian), na only one God wi get and naim bi awa Papa. Na-im kreate evritin and wi dey live for am. Na Jesus Christ bi awa only Oga God. Na-im make evritin and na thru am wi get life.


God go komplete en plan wen di time don rish, den E go gada evritin wey dey heaven and eart togeda under Christ, wey bi di head.


Bikos, wi nor dey fight against human being, but na against di wiked rulers wey dey for dis world, against evil spirits and pawas wey dey di heavens.


So make una remember dis tins kon keep am well for una heart: Na di Oga God bi God, both for heaven and for eart and know oda god, dey.


so dat wen dem koll Jesus name, evribody and evritin must knee down, weda dem dey heaven, eart or for under di eart


God wey wi nor dey si, na Jesus bi en image and for evritin wey E kreate, na Jesus bi di first.


and thru Christ blood wey e pour out for us for di cross, God go draw evritin back to ensef afta E don make peace with tins for heaven and eart.


And una dey komplete inside am; bikos na-im bi di head for all di pawas wey dey for heaven and eart.


God disgrace wiked and evil rulers for publik, wen E win dem for di cross.


but naw, E dey tok to us thru en pikin wey get evritin and na thru am, E kreate di world.


Dis na true, bikos na from am and thru am evritin take kom dis life, so dat salvashon go dey korrect thru en sofa and e go karry many pipol enter en glory.


go heaven kon go sidan for God rite hand, where e dey rule di angels and doz wey get pawa.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan