I don kom diliver dem from Egypt pipol, den karry dem go anoda land wey dey good and big. Di land wey milk and honey dey flow for di aria where Kanaan, Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol dey stay.
una must drive all di pipol wey dey stay di land komot. Make una distroy all dia juju wey dem make with stone or iron and all di place where dem for dey woship di juju.
Wen all di kings for Jordan River west; di kountries for hill; di ones for di valley go rish Mediterranean wotaside; plus di whole Lebanon (plus Hit, Amor, Kanaan, Periz, Hiv and Jebus pipol) hear about Israel pipol and wetin dem do,
I sey make una nor make kovenant with di pipol wey dey dis land and make una distroy dia altar, but una nor do wetin I tell una. ‘Wetin make una do like dis?’
Na di nashon dem bi dis: Filistia pipol (doz wey dey under di five Filistia rulers), all Kanaan, Sidon and Hiv pipol wey dey stay for Mount Lebanon; from Baal-Hermon mountin go rish Lebo-Hamat.