Gibeon pipol nor dey join Israel pipol; dem bi small tribe for Amor wey Israel pipol promise sey, dem go protet, but Saul don try to distroy dem, bikos of en love for Judah and Israel pipol.
Adoni-Zedek wey bi Jerusalem king hear how Joshua take enter Ai town kon distroy am and en king, just as e do to Jeriko and en king. E still hear how Gibeon pipol make peace with Israel pipol kon dey stay togeda.