sey, “Go di temple go tell all di pipol from Judah wey dey kom woship for der, evritin wey I kommand yu. Make sure sey yu nor forget anytin wey I tell yu.
Make una gada di pipol; prepare dem for di holy meetin; bring di old pipol, den gada all di shidren too. Even pipol wey just marry must kom out from dia bedroom.
God wey dey lead heaven sojas sey, “For dat time, ten strenjas go kom meet one Jew pesin sey, ‘Wi won share from yor blessings, bikos wi hear sey God dey with yu.’ ”
But wen Jesus si wetin dey happen, e vex kon tell en disciples, “Make una allow small-small shidren kom meet mi, nor stop dem, bikos na pipol like dem, go enter God Kingdom.
Wen wi don stay der for sometaim, wi kon travel komot der. All of dem with dia wife and pikin escort us go outside di town. Wi knee down pray for di wotaside
Make una gada all di pipol: men, wimen and shidren, plus all di strenjas among una, so dat dem go hear, learn and know how to fear di Oga una God kon obey all en law.