Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 8:31 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

31 just as God savant Moses don kommand Israel pipol. As dem tok for di Law Book wey Moses rite, dem make am with stone wey dem nor kut or break or wey any iron don tosh. Dem burnt sakrifice for der kon do sakrifice for peace.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 8:31
16 Iomraidhean Croise  

But e nor kill di savant shidren. E obey God kommand, just as dem rite for Moses Law sey, “Make una nor kill papa, bikos of wetin dia pikin do and make una nor kill pikin, bikos of wetin dia papa do. If una must kill anybody, make e bi for en own sin.”


Hilkaya wey bi di High Priest kon tell Shafan di kourt seketry sey, “I don si di Law Book for God Temple.” Hilkaya give di book to Shafan and e read am.


E nor kill dia papa, bikos e obey God kommand wey dem rite for Moses Law sey, “Make dem nor kill pikin, bikos of en papa sin or kill papa, bikos of en pikin sin.”


Den dem divide di burnt ofrin among di pipol akordin to dia family, so dat dem go fit offa dem akordin to di kommand wey Moses give dem.


Dem still arrange di priests and Levi pipol wey go dey serve for di temple for Jerusalem, just as dem rite am for Moses Law.


Wen dem dey read Moses law give di pipol, dem kon rish di place wey sey make dem nor allow any Ammon or Moab pesin join God pipol.


Den Jetro sakrifice and burn ofrin for God. So Aaron and all di eldas for Israel join Moses wife papa chop di food for God present.


E send some yong Israel men and dem go offa burn ofrin kon sakrifice one yong melu as peace ofrin to God.


So if Satan dey drive Satan komot, e don divide ensef bi dat, den how en kingdom go fit stand?


Wen una cross Jordan River kon enter di land wey di Oga una God dey give una, make una gada some big stones kon pash dem.


Una must rite all dis kommand for di stone and una go rite am as evribody go fit take si am.”


Dis law wey God give yu must nor komot from yor mout! Yu must dey read and tink of am evriday and nite, so dat yu go fit obey evritin wey dey inside. Den yor way go dey rite and evritin go betta for yu.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan