Adoni-Zedek wey bi Jerusalem king hear how Joshua take enter Ai town kon distroy am and en king, just as e do to Jeriko and en king. E still hear how Gibeon pipol make peace with Israel pipol kon dey stay togeda.
Wen Ai men turn back, dem si smoke from dia town dey go heaven and fear katch dem and dem nor fit run go anywhere. Dis time, di men wey dey run before go di desert kon turn back face Ai men wey dey porshu dem.