Na dem bi demon spirit wey dey do mirakle. Na dem dey go gada all di kings wey dey for di world, so dat dem go fight di fight wey go happen for di day wey God Almighty go judge di world.
Wen Benjamin pipol kom out kon fight, dem lead dem komot for di town. Just as before, dem bigin kill some Israel pipol, dem kill rish thirty Israel pipol for di open land and di road wey dem dey pass go Bethel and Gibeah.