Di land wey Joshua give Josef shidren na from Jordan River side go rish di wotaside for Jeriko east; den to di desert and from Jeriko go di kountry for di hill wey bi Bethel.
Wen Ai king si Israel pipol, en and all en sojas kwik-kwik get up di next day go fight Israel for Arabah. But Ai king nor know sey some men hide for di town back.
Den Benjamin sojas kon know sey, dem don luz. Israel main sojas bin dey run from Benjamin sojas, bikos dem won give doz wey still hide for bush, di shance to attack Gibeah town.
So dem turn kon dey run from Israel sojas go di open land, but dem nor fit eskape di fight and dem kill all di pipol wey kom out from di town wey dey near der too.