Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 7:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 Dem pak many stones on-top dem (di stones dey der till today) and God vexnashon kon stop. So till today, na Akor Valley dem dey koll dat place.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 7:26
22 Iomraidhean Croise  

Dem karry Absalom body trowey for one deep pit for di forest kon use many stone kover am. So Israel pipol kon run go dia house.


den e beri Saul and Jonatan bones for Saul papa, Kish, grave for Zela wey dey Benjamin aria and di pipol do evritin wey di king kommand. Afta evritin wey dem do, God kon ansa Israel pipol prayer.


I won make kovenant with di Oga wey bi Israel pipol God, so dat E nor go vex again.


Make awa leaders handle di matter. Den make doz wey marry woman from anoda kountry, kom gada with di leaders and judge dem for di town for di time wey dem gri sey make wi meet, until God nor go dey vex for us again.”


My God wey dey diliver us, make Yu save us again! Make Yu nor dey vex for us!


Why Yu won let Egypt pipol sey, ‘Dia God save dem with di mind to kill all of dem for di mountin kon distroy dem komot from di eart?’ Make Yu shange yor mind about wetin Yu won do yor pipol, so dat Yu nor go dey vex for dem.


Give Jerusalem pipol heart. Tell dem sey dem don sofa rish and God don forgive dem dia sins. Yes! I don ponish dem well-well for dia sins.


Dem go woship mi kon lead dia sheep and melu go chop grass for Sharon and for Akor Valley for east.


Dem trow mi inside one pit kon dey drop stone for my head.


I go gi-am back en vineyard den Trobol Valley go kon bi Hope Valley. E go ansa mi for der, just as e do wen e dey yong for di time wen e dey komot from Egypt.


I go remove Baal name from yor mout and yu nor go ever take about am again.


Nor bi just to tear una klot, but make una heart show sey una don turn from sin kom meet mi.” Make una kom back kon meet di Oga wey bi una God. E dey kind and dey show mesi; E dey patient and dey keep en promise; E always dey ready to forgive and nor bi to ponish pipol.


Den God go sorry for di land kon pity for en pipol.


So dem trow Jonah inside di wota, den di breeze kon stop.


Den Oga God koll and tell mi, “Si, di shariot wey go di nort side don make mi stop to vex for di pipol for di land.”


follow di Israel man enter en tent, den kill di two of dem. So di wahala wey dey distroy Israel pipol kon stop.


Anytin wey God sey E go judge, una must nor take am at-all. Den God nor go vex again, but E go sorry for una kon make una plenty as E promise una grand-grand papa.


Di Oga una God go sorry for una only if una listin to en vois, keep en kommand wey I tell una kon dey do wetin dey good for en eye.


Wen sun don go down, Joshua kon sey make en men bring di kings body kom down from di tree kon trow dia body inside di hole wey dem hide put before, den pak big-big stones take kover di hole. (Dem still dey der till today.)


Den Joshua and Israel pipol take Akan, Zera pikin with di klot, di silva, di gold, en shidren, melu, donkey, sheep, tent and evritin wey bi en own go Akor Valley (wey mean Wahala Valley).


Joshua hang Ai king for tree kon leave am for der until evening. Wen sun don go down, Joshua kon tell di sojas sey make dem take di king dead body komot for di tree. Dem trow am put for di town gate kon pak stone on-top am (na so e bi till today).


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan