Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 7:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

24 Den Joshua and Israel pipol take Akan, Zera pikin with di klot, di silva, di gold, en shidren, melu, donkey, sheep, tent and evritin wey bi en own go Akor Valley (wey mean Wahala Valley).

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 7:24
18 Iomraidhean Croise  

I know sey Yu nor go do dat kind tin. Yu nor go kill pipol wey dey good with di bad ones.”


Wiked pipol go vomit di money wey dem tif. God go take am back with di ones wey dey dia belle.


Make una nor bow or serve dem, bikos na mi bi di Oga una God and I dey jealous well-well. I bi God wey dey ponish shidren and dia shidren-shidren, bikos dia papa Rijet mi.


Long-trot dey kill pesin family finish, but doz wey hate bribe, go get long life.


E get anoda sirious problem wey I don si for dis world. Pesin money fit bring wahala for am.


Dem go woship mi kon lead dia sheep and melu go chop grass for Sharon and for Akor Valley for east.


I go gi-am back en vineyard den Trobol Valley go kon bi Hope Valley. E go ansa mi for der, just as e do wen e dey yong for di time wen e dey komot from Egypt.


E kom from der go Debir from Akor Valley den turn face nort go rish Gilgal (wey dey opposite Adummim Pass for di sout-side for di valley) kon cross En-Shemesh wota go rish En-Rogel.


Wen Zera pikin, Akan nor gri obey di kommand about di town tins, na di whole town sofa am, even doh na only one man sin. And nor bi only en die for di sin wey e kommit.’ ”


But make una take kare wen una dey keep di tins wey bi God own. If una take any of dem, una go kause wahala for awa kamp and awa pipol.


Dem use dia swod take kill evritin wey dey breath for di town, both man and woman, small pikin and old pipol, plus all di animals.


Israel pipol disobey wetin dem tell dem about di tins wey dey Jeriko. Akan wey bi Karmi pikin, wey Zabdi born, wey Zera born from Judah tribe, kon tif some tins from Jeriko, so God kon dey vex for Israel pipol.


Dem take all of dem from di tent centre kon go give Joshua and Israel pipol kon put am for where God go for si am.


Dem pak many stones on-top dem (di stones dey der till today) and God vexnashon kon stop. So till today, na Akor Valley dem dey koll dat place.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan