King Hezekaya show sey e happy well-well as Levi pipol use all dia mind dey serve God. Dem do di feast for seven days, dey give ofrins and dey tank God wey bi dia grand-grand papa God.
Make una respet di Oga una God, before E go bring darkness wey go make una kick stone fall on-top mountins! Make una respet am, before E go turn una lite to darkness.
I pray to God kon konfess all di bad tins wey wi don do sey: “God! Yu get pawa well-well and wi dey honor Yu. Yu dey keep yor promise and Yu love pipol wey love and dey obey Yu.
Make yu tish old men sey, make dem nor dey bihave anyhow, so dat pipol go respet dem and make dem dey kontrol demsef; get faith; dey show love and dey patient.
den di heat kon dey burn pipol, yet dem still dey curse God wey get pawa to stop dis sofa and dem nor gri turn from sin kom meet God or gi-am all di glory.
Una go make image wey bi like di sore and rat wey dey distroy di whole land, den kon honor Israel God. May bi E go sorry for una, una gods and una land.