18 Joshua sey make Zabdi Family kom man by man and God kon choose Akan wey en papa na Karmi and Karmi papa na Zabdi wey bi Zera pikin and Zera kom from Judah tribe wey God choose.
So God sey, “Just as dem dey disgrace tif wen dem katch am, na so too I go disgrace Israel pipol, dia kings, ofisas, priests and profets, bikos of wetin dem do.
“But if una nor do wetin una promise, I dey warn una, bikos na sin una don kommit against God bi dat. Make una nor konfuse unasef; bikos una go must get di ponishment for una sin.
Joshua sey make di pipol for Judah kom village by village and God kon choose Zera village. Joshua sey make Zera pipol kom family by family and God kon choose Zabdi family.