15 Di pesin wey dem katch with di propaty, dem must burn am with evribody wey bi en own, bikos e nor do wetin God tok and e don disgrace Israel pipol.’ ”
By dis time, Jakob sons don kom back from di field, but as soon as dem hear wetin happen, dem kon dey vex well-well, bikos wetin e do nor good at-all, bikos dis kind tin nor suppose happen for Israel.
How I go take face pipol for publik again? Dem go disgrace yu for Israel too. So abeg, make yu go tell di king, I dey sure sey e go give mi to yu as yor wife.”
Israel pipol don sin; dem don go against my kommandment! Dem take some tins wey I sey make dem keep for mi from Jeriko; dem tif dem kon put dem join dia own propaty.
Wi go still pick one out of evry ten from di men for each tribe, wey go dey supply di sojas food, den wi wey remain go attack Gibeah for Benjamin town, bikos of wetin dem do to Israel.”
Saul kon ansa, “David my pikin, I don sin! Make yu kom back. I nor go kill yu, bikos yu don save mi today. I bi like fool today and I don make big mistake.”