Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 7:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Israel pipol nor fit stand for dia enemies front; dem run bikos disgrace don dey follow dem. I nor go dey with una again, unless una distroy wetin make dis wahala dey happen to una.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 7:12
21 Iomraidhean Croise  

Yu make us run from awa enemies kon allow pipol wey hate us, pak awa propaty.


My God, Yu don rijet us? Yu nor go follow awa sojas go war again?


Wiked pesin dey run wen nobody dey porshu am, but honest pesin dey get heart like lion.


Na bikos of una sins make am nor dey hear una. Na una sins dey separate una from God wen una try to woship am.


God tell mi, “Jeremaya, if anybody among my pipol, or profet or priest ask yu, ‘Wetin God tok?’ Make yu tell dem sey, ‘Una dey disturb God and E go distroy una.’


So Jerusalem pipol, make dis one bi warnin to una, if not, I go forget una kon make una land empty and nobody go fit stay der.”


Even if dem born, I go kill di pikin. Bad-bad tins go happen to dis pipol wen I don leave dem.”


Yor eyes too dey holy to si bad tins and Yu nor dey like si pipol wey dey do wiked tins. So wetin make Yu dey sorry for dem? Wetin make Yu kwayet wen wiked pipol dey distroy pipol wey good pass dem?


Wen Moses tell Israel pipol wetin God tok, dem kon dey komplain more-more.


Make una nor go, bikos God nor dey with una and una enemies go win una,


bikos Amalek and Kanaan pipol dey wait una and dem go kill una well-well. Bikos una don turn from God, E nor go-go with una.”


Amalek and Kanaan pipol for der kon attack and porshu dem go rish Hormah.


Any propaty wey God nor like, make una nor take am enter una house, bikos if una do so, God go distroy una just as E do to doz pipol. Make una make sure sey una nor do dat kind tin, bikos God go distroy dem.


But make una take kare wen una dey keep di tins wey bi God own. If una take any of dem, una go kause wahala for awa kamp and awa pipol.


Den e shaut, “Samson! Filistia pipol don kon katch yu!” E wake-up kon tell ensef, “I go do as I dey do before, I go shake mysef and dey free.” E nor know sey Oga God don leave am.


Bikos of dis, God vex well-well for dem, so E let tif karry all wetin dem get. E allow dia enemies opress dem and dem nor fit protet demsef again.


Wen God angel don tok to Israel pipol finish, all of dem kon dey kry.


Den Saul sey, “Una wey bi di sojas oga, make una kom. Make una find out who make di pipol sin today.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan