Israel pipol don sin; dem don go against my kommandment! Dem take some tins wey I sey make dem keep for mi from Jeriko; dem tif dem kon put dem join dia own propaty.
Wen Kanaan pipol and evribody wey dey stay di land go hear wetin happen so, all of dem go kom distroy us and nobody go remember us. My Oga God, wetin Yu go do to keep yor respet?”
God tell Samuel, “Na how long yu won to dey sorry for Saul? I don rijet am as Israel king. So put olive oil for yor horn make yu dey go. I dey send yu go meet Jesse for Betlehem, bikos I don choose my king from among en sons.”