Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 6:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 For dat time, Joshua kon swear sey: “Anybody wey sey e won build Jeriko town again, God go kondemn am. “E first boy pikin go die as e stay to build am and en last boy pikin go die wen e dey put di gate!”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 6:26
9 Iomraidhean Croise  

For di time wey e bi king, Hiel wey kom from Bethel kon build Jeriko again. As God don tok thru Joshua wey bi Nun pikin, Hiel first pikin, Abiram, die wen dem start to build Jeriko foundashon and en last born, Segub kon die wen dem dey won put di town gate.


But King Ahab ansa, “How many times I go tell yu sey, if yu dey tok to mi with God name, make yu dey tell mi di trut?”


Elijah kon tell Elisha, “Make yu stay here wait mi, bikos God send mi go Jeriko.” But Elisha ansa, “As long as God and yu dey alive, I nor go leave yu.” So dem kon go Jeriko togeda.


Esau shidren-shidren wey bi Edom fit sey, “Even doh awa towns don skata finish, wi go build dem again.” But God wey dey lead heaven sojas ansa, “Make una go ribuild dem, but I go still skata dem and pipol go koll una kountry, ‘Di Land wey Wikedness Full’ and dem go koll una pipol, ‘Di pipol wey Oga God go always dey vex with.’ ”


But Jesus kwayet. Den di High Priest kon tell am, “I take God name kommand yu to tell us if yu bi Christ, wey bi God Pikin.”


But some Jew wey dey waka about kon try to koll Jesus Christ name for pipol wey evil spirit dey disturb dey sey, “I kommand yu with Jesus Christ name wey Paul dey prish.”


E from Janoah go Atarot and Naarah kon tosh Jeriko till e rish Jordan River.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan