Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 6:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

23 So di men go bring Rahab, en papa, mama, brodas and evribody wey dey en house. Dem bring all en family kom out kon take dem go one place wey dey outside Israel pipol kamp.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 6:23
15 Iomraidhean Croise  

“Den I go turn yu to one strong kountry kon bless yu. Yor name go dey great and yu go get betta blessing.


Wot of if pipol wey dey fear Yu rish fifty for dat town? Yu go distroy di whole town? Yu nor go bikos of di fifty pipol leave di town?


But wen God distroy di town and valley where Lot dey stay. E keep Abraham for en mind kon allow Lot run komot di town.


“Naw all of una wey don kill pesin or wey tosh dead body go stay outside di kamp for seven days and for di third and sevent day, make una and di wimen wey una katch klean unasef.


E tell dem, “Una know sey di law nor allow us, wey bi Jew pipol, to visit Gentile pipol or follow dem do anytin, but God don show mi sey make I nor sey anybody nor dey klean.


kon sey, ‘Make yu nor fear Paul! Yu must face Caesar and God go save yu and evribody wey dey follow yu travel.’


Wetin go make mi judge pipol wey nor dey di church? Nor bi doz wey dey inside wi suppose to judge?


Dat time, una dey without di Mezaya and una nor get share for Israel blessings and since una nor get hope and una dey without God for dis world, una kon bi strenja to God kovenant wey E promise Israel pipol.


Na faith make Rahab, wey bi ashawo, eskape wen God distroy pipol wey nor obey am, bikos e welkom di pipol wey kom spy.


Na faith make Noah build ark afta God warn am about wetin go happen. E obey wetin God tok and na di ark save en and en family. Na di same faith Noah take kondemn di world, kon inherit di raitiousness wey dey kom.


una nor go kill my papa, mama, brodas, sistas and evritin wey bi my own.”


Rahab tell dem, “Make una run go di kountry for di hill, so dat who dey porshu una nor go si una and make una stay der for three days. By dat time, pipol wey dey porshu una go don kom back, den una fit go una own.”


Wen wi attack dis land, make yu tie dis red rope for di window wey yu for allow us kom down, den go pak all yor family enter yor house and evribody where dey stay yor papa house.


So e show dem and dem kill evribody wey dey di town, escept di man and en family.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan