Di profet kon tell di king, “Dis na wetin God sey make I tell yu, ‘Bikos yu let di man wey I sey make dem kill eskape, yu go use yor life pay for en own and dem go distroy yor sojas, bikos dem let en sojas eskape.’ ”
Yu wey dey stay for Dibon, kom down from yor place where honor dey kon sidan for san-san; bikos di pesin wey distroy Moab and skata en strong-strong buildings, go distroy una too.
Una must gada all di dirty for der kon put am for di street centre, den burn di town rish groun as ofrin to di Oga una God. Una must distroy di town forever and make nobody build am again.
All di kountries wey di Oga una God dey give una, una must distroy all of dem finish. Make una nor sorry for dem at-all and make una nor woship dia gods, if not dem go trap una.
Dem enter di town, katch di king and all di towns wey dey near am, den dem kill evribody wey dey stay der; nobody survive. Dem kill evribody, just as dem do for Hebron, Libnah and to dia kings.
Make yu do wetin yu do for Jeriko to Ai, en king and en pipol, but una fit keep dia animals for unasef. Naw, make una dey ready to attack di town from back!”
So make yu go kill Amalek pipol. Yu go distroy evritin wey dem get. Nor leave anybody or anytin. Kill evribody both man, woman, yong pikin, melu, sheep, kamel and donkey.’ ”