20 Wen di sojas hear di ram horn sound, dem kon shaut well-well for war. Di town wall fall rish groun and di sojas run enter di town at wons kon win Jeriko pipol.
Judah men and King Abijah wey dey lead dem kon shaut kry give God, so God kon help dem win Jeroboam and Israel sojas.
For dat day, trumpet go dey blow and war go dey evriwhere. Evriwhere for di town go dey shake; even di walls wey strong well-well, go fall skata!
Na faith make Jeriko wall fall afta Israel pipol don mash round am for seven days.
Wen una hear di trumpet sound, make di sojas shaut for war and di town wall go fall rish groun, den una go attack am.”
Wen God Kovenant Box rish di kamp, Israel pipol kon shaut well-well, sotey di groun kon dey shake.