Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 6:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 But make una take kare wen una dey keep di tins wey bi God own. If una take any of dem, una go kause wahala for awa kamp and awa pipol.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 6:18
20 Iomraidhean Croise  

Wen David bi king, strong honga kon dey and e last for three years. So David ask God and E ansa am sey, “Saul and en family dey guilty, bikos dem kill pipol. Dem kill Gibeon pipol.”


So wisdom dey good pass swod, but one sin fit distroy many-many good tins.


Jonah ansa, “Make una trow mi inside di wota and di breeze go stop. Bikos na mi kause dis wahala for una.”


Make wi love each oda well-well. Make una hate anytin wey dey bad, but una must love anytin wey get trut.


Christ still sey, “Make una kom out and separate unasef from dem,” and “Make una nor tosh anytin wey nor dey klean, den I go welkom una


Make una nor put hand for bad tins, instead, make una dey espose dem.


Anytin wey God sey E go judge, una must nor take am at-all. Den God nor go vex again, but E go sorry for una kon make una plenty as E promise una grand-grand papa.


If anybody dey among una wey nor dey klean, bikos of wetin e do with en body for nite, e must komot di kamp and e nor go enter for sometaim.


Any propaty wey God nor like, make una nor take am enter una house, bikos if una do so, God go distroy una just as E do to doz pipol. Make una make sure sey una nor do dat kind tin, bikos God go distroy dem.


But betta relijon wey nor get stain for God eye, naim bi dis: to kare for shidren wey nor get papa and mama and wimen wey dey sofa bikos dia husband don die. So, make una keep unasef, so dat dis world nor go stain una.


Israel pipol disobey wetin dem tell dem about di tins wey dey Jeriko. Akan wey bi Karmi pikin, wey Zabdi born, wey Zera born from Judah tribe, kon tif some tins from Jeriko, so God kon dey vex for Israel pipol.


“Make yu get up! Go santify di pipol make yu tell dem: ‘Make una santify unasef before tumoro, bikos Israel God sey, “Israel pipol, una body dey dirty! Una nor go fit fight una enemies until una remove wetin make una dirty.”


Di pesin wey dem katch with di propaty, dem must burn am with evribody wey bi en own, bikos e nor do wetin God tok and e don disgrace Israel pipol.’ ”


Joshua kon sey, “Wetin make yu bring wahala for awa head? God go put wahala for yor head today!” So, evribody for Israel stone en, en family and evritin wey e get until dem die finish, den dem kon burn dem.


So my shidren, make una make sure sey una nor get anytin to do with oda gods.


Saul and en sojas nor kill king Agag and dem nor distroy di betta tins and animals. Dem nor kill all di animals, but dem kill and distroy di tins wey nor good for di town.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan