14 Dem mash round di town ones for di sekond day, den dem go back to dia kamp. Dem do like dis for six days.
So Joshua make sure sey dem karry di Kovenant Box round di town only ones a day. Den dem go back go sleep for dia kamp.
Di seven priests wey karry di seven ram horn for di Kovenant Box front, mash dey blow di horn round di town. Many sojas dey mash for dia front, while di oda guide dey follow for back and dem dey blow dia horn too.
For di sevent day, dem wake-up for early morning kon mash round di town as before, but dis time, dem mash round am seven times.
Make una sojas mash round di town ones and make una do like dat for six days.