10 Naw, Joshua tell di sojas, “Make una nor shaut or make nois; make una nor tok anytin until di day wey I go tell una sey make una shaut or make nois!”
Naw, dis na wetin God tok, “I dey put one foundashon stone for Zion and dem rite dis word put, ‘Di pesin wey bilive and get faith, make e nor fear.’
E nor go shaut or make nois or dey tok waka for strits.
E nor go kworel or shaut, nobody go hear en vois for publik, e nor go tosh pesin wey weak,
I dey send wetin my Papa promise kom meet una. So make una stay for dis town until pawa go kom from heaven kon kover una.”
Jesus ansa dem, “Di time wey God plan nor koncern una,
So Joshua make sure sey dem karry di Kovenant Box round di town only ones a day. Den dem go back go sleep for dia kamp.
Many sojas dey mash for front of di priests wey dey blow di horn, while di oda guards dey mash follow di box for back dey blow ram horn too.