Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 5:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 For dat time, God kon tell Joshua, “Make yu use stone take make knife kon sekonsaiz Israel pipol again.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 5:2
8 Iomraidhean Croise  

But en wife Zipporah kut en son skin with knife kon take am tosh Moses leg, den e sey, “True-true, I don take yu from deat hand and yu bi my husband wey I marry with blood.”


but di really Jew na pesin wey bi Jew for inside en heart, bikos sekonsishon nor dey tosh pesin heart. Na di Holy Spirit dey do dis kind work, nor bi di law wey dem rite down and dat pesin go dey receive praiz from God, even doh human being nor praiz am.


But leta, dem sekonsaiz am. Dis sign show sey, bikos of en faith, God don si am as raitious pesin, so dat e go bi papa to evribody wey bilive God, pipol wey God don asept, even doh dem neva sekonsaiz.


So make una shange una heart and stop to dey do strong head.


Di Oga una God go sekonsaiz una and una shidren heart by ensef, so dat una go love am with all una heart and soul, den una go get betta life.


Dem sekonsaiz una inside am. Dis nor bi human being sekonsishon, but na di spirit own wey Christ dey do.


So Joshua make di knife kon sekonsaiz dem for where dem dey koll Sekonsishon Hill.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan