Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 4:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 den make una tell dem how Jordan River take stop to rush, bikos of God Kovenant Box. Wen di box cross Jordan River, di wota stop to rush. Dis stones go make Israel pipol dey always remember wetin happen.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 4:7
11 Iomraidhean Croise  

E dey make us remember en wonderful works, bikos awa God dey good and dey show mesi!


Una go dey remember dis day and celebrate am to di Oga una God forever.


Make yu put di two stones for di priest garment shoulder, so dat e go stand for Israel sons and Aaron go karry dia name go meet God, just to dey always remind am about dem.


Yu go kollect dis money from Israel pipol kon use dem take maintain di Tabanako. Bikos of dis, Israel pipol go always dey Oga God mind and E go klean una life.”


Wiked pipol dey do tins for God like sey dem dey do am give juju and dis kind tin dey make God vex for dem. Weda dem kill melu as sakrifice, dem go dey guilty like sey dem kill human being. Even if dem sakrifice lamb, e go bi like sey na dog dem sakrifice; even if na rice dem present, dem go dey guilty like sey dem offa pig blood as ofrin; or if dem offa incense give God, dem go still dey guilty like who offa am give juju, bikos dis pipol don choose dia own way and dem like di yeye tins wey dem dey do.


Dis na warnin to Israel pipol sey, “Anybody wey nor kom from Aaron family, nor go fit burn incense to God for di altar. If not, e go die like Korah and en men.” All dis happen akordin to wetin God kommand Eleazar thru Moses.


And di man stik wey I go choose go prosper; so I go stop Israel pipol to dey komplain against yu.”


and afta e don tank God, e divide am kon sey, “Dis na my body wey I dey give una. Make una always dey chop am to remember mi.”


Make una chop am with bread wey dem nor make with yist and una go chop dis bread for seven days, just as e bi wen una rush dey komot from Egypt. Make una chop dis bread (bikos na-im una chop wen una dey sofa), so dat as long as una dey alive, una go remember di day wey una komot from Egypt.


Di stones go make una dey remember dis tin wey happen and wen una shidren-shidren ask sey, ‘Wetin make dis stones dey important to una?’


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan