Den yu go tell dem sey, ‘Make una pick twelf stones from Jordan River centre, di very place where di priests stand put.’ Den, dem go karry di stones follow yu and yu go put am for di place where una go stay dis nite.”
kon tell dem, “Make una go for di Oga una God box front wey dey Jordan River centre. Each of una go put one stone for shoulder akordin to di tribes for Israel.