Elijah kon tell Elisha, “Make yu stay here wait mi, bikos God send mi go Jordan River.” But Elisha ansa, “As long as God and yu dey alive, I nor go leave yu.” So dem kon go togeda.
King Hezekaya and all di ofisas tell Levi pipol sey make dem use David and Profet Asaf psalms take praiz God and dem kon dey happy as dem dey praiz and woship God.
I give orda sey make Levi pipol go santify demsef, den kon guide di gate to make sure sey dem keep di Sabat Day holy. My Oga God, make Yu still remember mi kon save mi, bikos of yor great love.
Naw, Eliashib wey bi di priest born Joiada, but one for Joiada pikin marry Sanballat dota, wey kom from Bet-Horon town, so I sey make Joiada komot from Jerusalem.
Moses kon tell di pipol, “Make una nor fear! Make una get faith and una go si how God go take save una; bikos dis Egypt sojas wey una dey si today so, una nor go ever si dem again.
For Jordan River centre, di priests wey karry di Kovenant Box, stand well for dry groun. All di pipol for Israel cross pass for dry groun until evribody for di kountry cross finish.