Wen Jesus don tok all dis tins finish, e look heaven kon sey, “My Papa, di time don kom wen yu go give glory to yor pikin, so dat yor pikin go give yu glory too.
Di hope wey I get bi sey, shame nor go ever fit katch mi; my heart go strong well-well and as I dey do naw, na so I go always dey do. Evritin for my body go praiz Christ, weda I dey alive or I don die.
I dey tok again, so dat yu go dey strong kon get heart! Make yu nor fear or shake, bikos mi wey bi di Oga yor God, I dey with yu for evritin wey yu dey do.”