Una leaders go free demsef and kon free una. From una enemies town, God go take una go back to una own land. Una kings go lead una again and God go guide una by ensef.”
Wen di pipol don komot from Sinai, wey bi di holy mountin, dem kon travel for three days. God Kovenant Box dey with dem for dat three days wey dem travel so and dem kon dey find where dem go fit rest put small.
So Joshua wey bi Nun pikin kon koll and tell di priests, “Make una karry di Kovenant Box and seven priests must karry seven ram horn for di Kovenant Box front.”