Dem karry am komot from Abinadab house for di hill kon go put am for one new truck wey melu dey draw. Uzza and Ahio, wey Abinadab born, na dem dey guide di truck.
Wen di pipol don komot from Sinai, wey bi di holy mountin, dem kon travel for three days. God Kovenant Box dey with dem for dat three days wey dem travel so and dem kon dey find where dem go fit rest put small.
Wen Aaron and en sons don kover di Holy Place and en tools finish; wen time don rish for di pipol to travel, Kohat pipol go karry doz tins; but dem nor go tosh anytin wey dey holy, bikos if dem tosh am, dem go die. Dis na Kohat pipol work for di tent.
But una go give dem gap wey rish 3,000 fit. Make una dey wosh, so dat una nor go dey klose to di Kovenant Box. Na dem go show una road, bikos una neva travel pass der before.”
Naw, di priests wey karry di Kovenant Box stand for Jordan River centre until di pipol do evritin wey God kommand, just as Moses tell Joshua. Di pipol cross kwik-kwik
So Joshua wey bi Nun pikin kon koll and tell di priests, “Make una karry di Kovenant Box and seven priests must karry seven ram horn for di Kovenant Box front.”
Dis ones nor spoil demsef with wimen, bikos dem bi virgin. Na dem dey follow di Lamb wen e dey go anywhere. God save dem as human being, so dat dem go bi di first fruit wey en and di Lamb plok.
Doz wey kom from Levi tribe, karry di Kovenant Box with di cupboard wey get di gold tins wey follow di box kon go put am near di big stone. So Bet-Shemesh pipol offa burnt ofrin and sakrifice to God.