5 “ ‘I send Moses and Aaron go Egypt kon skata Egypt rish groun wen I enter di land. Den I bring una kom out from Egypt.
So E take en pipol komot Egypt with joy; di pipol wey E choose with happiness.
Di Pesin wey kill all di first-born for Egypt, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
Israel pipol bigin travel with leg from Rameses go Sukkot. Israel men wey travel rish 600,000 (Dem nor kount wimen and shidren join am).
Israel pipol komot for Egypt for di day wey di four hundred and thirty years komplete.
For dat day, Oga God take Israel pipol komot from Egypt akordin to der tribe.
So naw, make yu go, bikos na mi dey send yu go meet Fero and make yu take my pipol Israel, komot from Egypt.”
Na dem bi di men wey tok to Fero, so dat dem go fit take Israel pipol komot from Egypt.
Afta, I take una papa dem kom out from Egypt and wen dem waka rish di Red Sea, Egypt soja porshu dem with shariot.