Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 24:32 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

32 Josef bone wey dem karry kom from Egypt, Israel pipol kon beri am for Shekem, for part of di field wey Jakob buy from Hamor sons (Na Hamor bi Shekem papa) and Jakob buy di field for one hundred silva koin.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 24:32
9 Iomraidhean Croise  

Den e buy di field where e bin build en tent put; E buy am from Hamor pikin wey bi Shekem papa for one hundred silva.


Bikos yu dey higher dan yor brodas, I go give yu di low side for di mountin wey I take from Amor pipol with my swod and bow.”


Den Josef tell en brodas, “Na die I dey so. But God go true-true kom meet and take una go di land wey E promise sey E go give Abraham, Isaak and Jakob.”


Josef kon make Israel pipol swear. E tell dem, “God go really kom meet una. Den una must karry my bones follow body komot from dis place.”


Moses pak Josef bones, bikos Josef don make Israel pipol swear wen e sey, “God go kom save una and una must karry my bones komot from dis place.”


E kon rish one town for Samaria wey dem dey koll Saikar, wey near di land wey Jakob give Josef, wey bi en pikin.


So Jakob and awa grand-grand papa dem go Egypt and dem die for der.


Dia bone dey der till dem karry dem go beri for Shekem for di grave wey Abraham buy from Hamor shidren.


Wen Josef life don dey end, na faith e take tok about di long travel wey Israel pipol go-go and e tell dem wetin dem go do with en bones.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan