Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 24:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 Di pipol ansa Joshua, “Lie-lie! Na God wi go serve till wi die!”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 24:21
9 Iomraidhean Croise  

All di pipol ansa, “Wi go do evritin wey di Oga awa God don kommand us.” So Moses go back go meet God kon tell am wetin di pipol tok.


Dem kon tell Moses, “Make yu tok to us and wi go listin, but make yu nor let God tok to us, so dat wi nor go die.”


So Moses tell di pipol wetin God tok and di pipol ansa, “Wi dey ready to do evritin wey di Oga awa God kommand.”


So e take di Kovenant Book kon read am make all di pipol hear and dem sey, “Wi dey ready to do and obey all di word wey di Oga awa God tok.”


Den, one among dem go sey, ‘I bi God own.’ Anoda one go sey ‘I bi Jakob pikin.’ and anoda one go rite God name put for en hand kon sey, I dey among God pipol and my name na Israel.”


Una don tok today sey na di Oga bi una God. And una don promise to do wetin E tok and obey en kommand, laws, rules and to do evritin wey E tell una.


If una forget God kon go woship anoda god, E go turn against una; E go bring wahala kom meet and distroy una, even doh E trit una as pikin before.”


Joshua tell di pipol, “Na una bi una own witness sey una dey sey, ‘Una go serve God till una die.’ ” Di pipol ansa, “Yes! Na wi bi awa own witness.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan