Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 24:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 God porshu all doz nashons komot for us, plus Amor pipol wey dey stay di land. So wi go woship di Oga God, bikos na-im bi awa God!”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 24:18
13 Iomraidhean Croise  

My God, I bi yor savant; yes, I bi yor savant wey dem born for yor house and Yu don free mi from di shains kon save mi from deat.


All dis tins dey happen, so dat yu go fit tell yor shidren and grand-shidren how I take fool Egypt pipol with my mirakles, make dem for know sey na mi bi God.”


Na God bi my pawa and Savior. Dis na my God and I go praiz am. My grand-grand papa dem God and I go sing about how E great rish.


Una land go start from di Red Sea go rish Filistia pipol sea and from di wildaness go rish di river. I go give una di pipol wey dey di land and una go drive dem komot from der.


Pipol from many nashons go kom and dem go sey, “Make una kom make wi go di Oga mountin wey bi Jakob God house, so dat E go tish us en laws and wi go do evritin just as E wont am.” Nor bi only di pipol for Zion and Jerusalem go hear God word, but oda nashons go hear am too.


God wey dey lead heaven sojas sey, “For dat time, ten strenjas go kom meet one Jew pesin sey, ‘Wi won share from yor blessings, bikos wi hear sey God dey with yu.’ ”


“Afta, awa grand-grand papa dem karry di Tabanako wey God give dem with Joshua kon drive all di oda tribes and take dia land till di time wey David bigin rule Israel.


Na only en bi God; di only one wey wi go dey praiz; di Pesin wey don do many wonderful mirakles wey una don si with una own eyes.


Na di God wey go dey forever bi una guide and provida. En hand wey go dey forever, dey support una. E drive all una enemies kon sey make una distroy dem!


“For una front, God porshu nashons wey get pawa well-well; nobody fit beat una kon rish today.


Bikos na di Oga awa God take wi and awa papa dem komot from sofa for Egypt kon do all doz mirakles for awa front. E still protet us wen wi dey travel pass difren kountries.


Joshua kon warn di pipol, “Una nor go fit dey woship God as E wont, bikos E dey holy. E dey jealous and E nor go forgive una if una turn from am kon sin.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan