Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 24:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 “ ‘Una cross Jordan River kon rish Jeriko. Di leaders for Jeriko, plus Amor, Periz, Kanaan, Hit, Girgash, Hiv and Jebus pipol kon fight una, but I make una win all of dem.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 24:11
25 Iomraidhean Croise  

plus Kenite, Kenizz, Kadmon,


Doz wey nor know am, E give dia land to Israel en pipol and dem plok fruit wey odas plant.


Di Red Sea si dem dey kom, kon run and Jordan River turn en face.


Red sea! Na wetin make yu dey run? Jordan River na wetin make yu turn yor face?


Afta God don take una enter Kanaan, Hit, Amor, Hiv and Jebus pipol land; di place wey E promise una grand-grand papa sey E go give dem, land wey good well-well, den una go dey celebrate dis feast for di first mont for evry year.


My angel go-go for una front till una rish Amor, Hit, Periz, Kanaan, Hiv and Jebus pipol land and I go distroy dem for una.


I go send fear like ant go drive Hiv, Kanaan and Hit pipol komot before una go rish der.


Una land go start from di Red Sea go rish Filistia pipol sea and from di wildaness go rish di river. I go give una di pipol wey dey di land and una go drive dem komot from der.


I don promise sey na from Egypt where una dey sofa naw, I go for take karry una go take-ova Kanaan, Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol land, di place where milk and honey full.” ’


I don kom diliver dem from Egypt pipol, den karry dem go anoda land wey dey good and big. Di land wey milk and honey dey flow for di aria where Kanaan, Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol dey stay.


And I go send one angel go before una rish der kon drive Kanaan, Amor, Hit, Periz, Hiv and Jebus pipol komot der.


Afta E don distroy seven tribes for Kanaan, E kon dash en pipol di land.


“Afta, awa grand-grand papa dem karry di Tabanako wey God give dem with Joshua kon drive all di oda tribes and take dia land till di time wey David bigin rule Israel.


Wen di Oga una God take una enter di land wey una go-go stay, E go porshu many kountries komot for una. Kontries like: Hit, Girgash, Amor, Kanaan, Periz, Hiv and Jebus pipol. (Di pipol for dis seven kountries get pawa pass una.)


Joshua sey, “Na like dis una go take know sey, God wey nor dey die dey with una and E go really porshu Kanaan, Hit, Hiv, Periz, Girgash, Amor and Jebus pipol komot for una.


Wen dem don cross finish, God kon tell Joshua,


Di pipol cross Jordan River for di tent day for di first mont kon stay for Gilgal wey dey di east side for Jeriko borda.


Di Oga una God dry Jordan River for una and una waka pass, just as E dry di Red Sea make wi waka pass.


dem kon join togeda won go fight against Joshua and Israel pipol.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan