5 Di Oga una God go drive dem komot for una, so dat una go fit stay dia land just as di Oga una God promise una.
“I go send one angel wey go protet una for front as una dey go and e go bring una kom di place wey I don prepare for una.
And I go send one angel go before una rish der kon drive Kanaan, Amor, Hit, Periz, Hiv and Jebus pipol komot der.
Make yu obey wetin I dey kommand yu today. I go drive Amor, Kanaan, Hit, Periz, Hiv and Jebus pipol komot for una.
Den God go drive all di kountries wey dey una front, aldo dem really strong and great pass una, but una go take dia land.
“I go porshu di pipol wey dey doz land komot for my pipol, Israel. All of dem wey dey stay di hill kountries from Lebanon go rish Misrefot-Maim, plus Sidon pipol, I go distroy dem, den yu go give dia land to Israel pipol, just as I tok.
I nor go drive any of di nashon wey Joshua nor fit win before e die.