4 Di nashons wey still remain, I don give dia land to una tribe, from Jordan River go rish Mediterranean Sea for west, plus all di nashons wey I win.
“I go give una Kanaan land and e go bi una special propaty.”
E porshu di nashons wey dey before dem kon divide dia propaty give en pipol. E make Israel pipol relax for dia house.
Na small-small I go take drive dem komot until una go plenty kon take-ova.
God distroy many nashons kon skata di walls for dia town. E skata dia street and nobody dey waka pass der again. Dia town don skata and nobody dey stay inside again.
Wen di Oga una God dey go for una front go distroy all di kountries and una drive dem komot kon stay di land,
and dem bi: Filistia pipol and Geshur aria,
For der, Joshua kon trow dice for God present kon divide di land among Israel pipol just as e suppose to bi.
I nor go drive any of di nashon wey Joshua nor fit win before e die.