If una obey di Oga una God kommand wey I dey give una today so, den una kon love di Oga una God; dey do as E tok; dey keep en rules, law and kommand, una go get long life kon dey many more-more and di Oga una God go bless una for di land wey una won enter as una own.
Den una go love di Oga wey bi una God kon dey obey en vois and hold am strong, bikos God go give una long life for di land wey E promise to give una grand-grand papa Abraham, Isaak and Jakob.”
But make una look well! Make una dey kareful, so dat una nor go forget wetin una don take una eyes si. As long as una dey life, make una nor let dis tins komot from una mind! Make una make sure sey una tell una shidren and grand-shidren about dis tins.