Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 23:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 E don tey since God don give Israel pipol rest from dia enemies and Joshua don old well-well.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 23:1
15 Iomraidhean Croise  

Den Abraham die for betta old age. E really old and live betta life. E die go join en grand-grand papa dem.


Naw, David don old well-well and even wen dem kover am with klot, kold go still dey katch am.


Den David sey, “Di Oga wey bi Israel God don give en pipol rest and E go stay Jerusalem forever.


Dis na di list of leaders for Israel family and tribe with ofisas wey dey kommand sojas and all of dem get dia work for di kingdom. Dem sey make each group dey serve one mont for evry year and na 24,000 men dey each group.


King Abijah die and dem beri am for David Town. En pikin Asa kon take-ova as king. Wen Asa dey rule, di land get peace for ten years.


Judah town get peace, bikos di king skata all di place and altar where dem for dey serve juju.


So, Jehoshafat kon get peace, bikos God dey protet am for evry side.


E stop all di war for di eart kon break di bow and skata di spear, den E burn di shield with fire.


Just as dem dey lead melu go valley wey get betta grass, na so too God dey give en pipol rest. E lead en pipol kon bring honor to en name.


“I don rish one hundred and twenty years naw and I nor go fit still bi una leader again. God don tell mi sey, ‘Yu nor go follow dem cross Jordan River.’


Joshua win di whole land, just as God promise Moses. Den Joshua give di difren tribe for Israel di land, as dia own. Den di land kon get peace and di war kon stop.


Wen Joshua don old, God kon tell am, “Yu don old and di land wey una go still fight for, many well-well


God dey protet dem, bikos of di promise wey E make with dia grand-grand papa. E nor get any enemy wey fit fight dem.


Naw, di Oga una God don guide una brodas and sistas, just as E promise dem. So make una go back to una house wey Moses, God savant divide give una for Jordan River east.


Naw, make una listin! Na dis king go lead una. I don old and get white hair full body, but my sons dey with una. I don dey lead una since wen I yong kon rish today.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan