Israel pipol, na una bi my witness. I choose una as my savants, so dat una go know, bilive and undastand sey na mi bi di only God. E nor get any oda god wey dey apart from mi. E neva dey before and e nor go ever dey.
but na to remind us and una and awa shidren-shidren sey, wi go woship God for en present with burn ofrin, sakrifice and peace ofrin. Den, tumoro una shidren-shidren nor go fit tell awa own sey, ‘Una nor get rite to woship God.’
Joshua tell di pipol, “Si, dis stones go bi witness against una, bikos e don hear evritin wey God tell una. E go bi witness against anybody wey deny awa God.”