30 Wen Finehas wey bi priest, di kommunity and di family leaders wey kom with am hear wetin Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe tok, body kon sweet dem well-well.
Wen dem hear wetin Pita tok, dem nor argue with am again, so dem kon start to praiz God. Den dem sey, “Naim bi sey God don give Gentile pipol di shance to take turn from sin kom meet am, so dat dem go get di life wey nor dey end.”
“Wi nor go ever disobey God and wi nor go fit turn back from God kon build altar wey wi go dey burn ofrin or do sakrifice put, apart from di altar wey dey awa Oga God Temple!”
Finehas wey bi Eleazar pikin and di priest kon tell Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe sey, “Today wi don know sey God dey among us, bikos una neva disobey God at-all. Naw, una don save all Israel pipol from God vexnashon.”
Wen dem tell Israel pipol evritin, belle sweet dem and dem kon tank God. Dem nor ever tok again sey dem go distroy Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe.
Si, na una use God pawa take kill Midian pipol two shief, wey bi Oreb and Zeeb. Wetin I do wey rish dat one?” Wen e tok like dis finish, di pipol kon stop to vex.
So Akish kon tell David, “I swear with God wey nor dey die sey, yu dey loyal to mi and na mi go happy pass sey yu follow mi go fight dis fight. I nor si anytin wey go let mi blame yu since di first day wey yu dey with mi kon rish naw. But di oda leaders bilive sey yu dey pritend.