E remove Israel pipol from David generashon and Nebat pikin, Jeroboam kon bi dia king. Jeroboam drive Israel pipol komot from God present kon enkourage dem to sin well-well.
From di time wey King Amazaya stop to follow God, pipol kon dey plan against am for Jerusalem. E run go Lakish, but dem send pipol follow am kon kill-am for der.
King Josaya remove all di juju from Israel pipol aria kon advise dem sey make dem serve God. For di time wen Josaya dey rule, di pipol nor sin against di Oga wey bi dia grand-grand papa God.
Den Moses tell Aaron and en two oda sons, Eleazar and Itama sey, “Make una nor barb una hair or tear una klot to show sey una dey mourn. If una do am, una go die and God go vex for di kommunity. But Israel pipol fit mourn, bikos God kill Nadab and Abihu.
Wen Zera pikin, Akan nor gri obey di kommand about di town tins, na di whole town sofa am, even doh na only one man sin. And nor bi only en die for di sin wey e kommit.’ ”
Israel pipol disobey wetin dem tell dem about di tins wey dey Jeriko. Akan wey bi Karmi pikin, wey Zabdi born, wey Zera born from Judah tribe, kon tif some tins from Jeriko, so God kon dey vex for Israel pipol.
Israel pipol don sin; dem don go against my kommandment! Dem take some tins wey I sey make dem keep for mi from Jeriko; dem tif dem kon put dem join dia own propaty.
From di tins wey wi karry from Jeriko, I si one fine klot from Babilon, with two silva koin and one gold wey heavy rish fifty fit. I like dem, so I take dem. I hide dem under di groun for my tent centre.”
If una fear God kon serve and obey am and una nor go against wetin E tok and if una and di king wey dey rule una follow di Oga una God, den evritin go dey well with una.