Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 21:44 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

44 God dey protet dem, bikos of di promise wey E make with dia grand-grand papa. E nor get any enemy wey fit fight dem.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 21:44
19 Iomraidhean Croise  

Israel pipol run from Judah sojas and God kon let Judah men win dem well-well.


Una land go start from di Red Sea go rish Filistia pipol sea and from di wildaness go rish di river. I go give una di pipol wey dey di land and una go drive dem komot from der.


God ansa, “My present go-go with yu and I go give yu rest.”


Just as dem dey lead melu go valley wey get betta grass, na so too God dey give en pipol rest. E lead en pipol kon bring honor to en name.


From Aroer wey dey River Arnon korna (River town), go rish Gilead, e nor get any town wey fit fight us. Di Oga awa God give us all doz towns.


Wen una dey go fight una enemies and di Oga una God make una win kon katch some of dem as una prisona


So, di really “Sabat Day” rest, still dey kom for God pipol.


“Hope una remember wetin God savant Moses kommand una? Di Oga una God go give una where una go stay and E dey give una dis land as una propaty.


until God don give una brodas where dem go stay like una and until una win di land wey di Oga una God don sey E go give dem. Den una fit go back to una place wey Moses, God savant don give una for Jordan River east.”


Nobody go fit stop yu still yu die. I go dey with yu as I dey with Moses. I nor go forget or leave yu.


Joshua enter all di royal towns kon kill dia kings, just as God savant, Moses kommand dem.


Joshua win di whole land, just as God promise Moses. Den Joshua give di difren tribe for Israel di land, as dia own. Den di land kon get peace and di war kon stop.


God give dem to Israel and en pipol kill and porshu dem go rish Greata Sidon, Misrefot-Maim and Mizpa Valley for di east. Dem kill all of dem finish.


Dem tell Joshua, “True-true, God don really give us di land, bikos evribody wey dey stay di land dey fear us well-well!”


Naw, di Oga una God don guide una brodas and sistas, just as E promise dem. So make una go back to una house wey Moses, God savant divide give una for Jordan River east.


So Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe kon leave Israel pipol for Shiloh wey dey Kanaan, den dem go dia own house for Gilead wey God give dem thru Moses.


E don tey since God don give Israel pipol rest from dia enemies and Joshua don old well-well.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan