For Hebron family, na Jeraya bi leader just as dem rite am. For di forty years wen King David dey rule, dem shek where dem rite am put kon si sey, dis men na pipol wey pipol dey respet for Jazer wey dey Gilead.
I go kry well-well for Sibmah and Jazer pipol. Sibmah town, yu bi like vine wey en branches rish Dead Sea den kon go Jazer town. But naw, yor fruit and grape wey yu plant for dry sizin, don skata.
Dis na all di towns for di aria plus di ones wey King Sihon for Amor wey dey rule from Heshbon, get. Moses win en and Midian leaders wey bi Evi, Rekem, Zur, Hur and Reba (all of dem dey under King Sihon).