But King Sihon nor gri make Israel pipol pass en aria; instead e gada all en sojas kon go attack Israel pipol for di wildaness. Wen e rish Jahaz, e kon fight against Israel pipol.
Dis towns na: Beza wey dey di wildaness high land for Reuben tribe; Ramot for Gilead wey bi Gad tribe own and Golan for Bashan wey bi Manasseh tribe own.
Afta dem cross Jordan River for di east side for Jeriko, dem kon selet Beza for di desert wey bilong to Reuben tribe, Ramot for Gilead wey bilong to Gad tribe and Golan for Bashan wey bilong to Manasseh tribe.