Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joshua 21:27 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

27 Dem give Gershon family for Levi tribe dis towns: from half of Manasseh tribe, dem give dem Golan for Bashan (di town wey pesin fit hide put make dem for nor kill-am) with Beeshtarah, all di aria for der and dem bi two big towns.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joshua 21:27
8 Iomraidhean Croise  

while Shema na Mahli pikin. Na Mushi born Mahli and na Merari bi Mushi papa. Merari na Levi pikin.


Dis na di land and field wey dem give Gershom tribe: For East Manasseh aria, dem give dem: Golan for Bashan and Ashtarot.


Dis tin happen for Edrei, afta dem win King Sihon for Amor, wey en soja oga na Heshbon and King Og for Bashan wey en sojas oga na Ashtarot.


Dis towns na: Beza wey dey di wildaness high land for Reuben tribe; Ramot for Gilead wey bi Gad tribe own and Golan for Bashan wey bi Manasseh tribe own.


Afta dem cross Jordan River for di east side for Jeriko, dem kon selet Beza for di desert wey bilong to Reuben tribe, Ramot for Gilead wey bilong to Gad tribe and Golan for Bashan wey bilong to Manasseh tribe.


Di rest for Kohat family get ten towns and dia aria.


From Issakar tribe, dem give dem: Kishon, Daberat,


Gershon shidren get thirteen big towns from Issakar, Asher, Naftali and half of Manasseh tribe wey dey Bashan.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan