Den King Asa send message go evriwhere for Judah sey make evribody help am karry di stones and timbas wey King Baasha take fence Rama komot. Asa kon use di tins take fence Mizpa and Gibeah wey bi towns for Benjamin aria.
E bring all di priests from Judah kon skata di high place where dem for dey offa sakrifice from Gibeah go rish Beersheba. E skata di high place dem for di goat juju wey dey di door-mot for Joshua gate wey bi di main town wey dey di left side.
All di land from Gibeah aria go rish Rimmon wey dey di sout, go klean like Arabah. But Jerusalem go high pass oda land wey dey round am; di town go start from Benjamin Gate go rish di Korna Gate kon from Hananel Towa go di Royal Wine press.